Why Matt Gaetz wey be Donald Trump choice for attorney general shock pipo
Donald Trump nomination and announcement of Congressman Matt Gaetz to be im attorney general sound very loud for Washington DC on Wednesday.
Of all di picks wey di president-elect don make for im administration so far, dis one na easily di most controversial one. E send clear message say Trump wan shake tins wen e return to power.
Di firebrand Florida politician dey most popular for being di pesin wey ginger di work to comot di den Republican Speaker of di House Kevin McCarthy last year.
For social media post, Trump tok how e wan use Matt Gaetz like wrecking ball to take radically change di US Department of Justice wey im say na di reason for all im plenti legal wahala.
Why Matt Gaetz nomination come as shock?
Gaetz get history of being in di middle of controversies for Congress.
For 2018, e carri right-wing Holocaust denier enta di State of di Union, and later try to pursue two papa wey dia pikin die inside mass shooting from one hearing afta dem bin object to a claim wey e bin make on top gun control.
Im bombastic approach mean say im get plenti enemies even di one for inside im own party. So, Trump choice of Gaetz dey show those Republicans say im second administration go dey full of loyalists wey im trust to go wit im agenda weda conventional political opinions like am or not.
Axios report say pipo shout during one meeting of Republican lawmakers wen du nomination for America top US prosecutor bin dey announced, axios report cite sources wey bin dey di room.
Tori be say Republican Congressman Mike Simpson of Idaho bin swear wen e hear am.
Alaska Republican Senator Lisa Murkowski tok say, “I no tink say na serious nomination for di attorney general. Dis one no dey my Bingo card.”
Gaetz sha get some padi-padi for Capitol Hill wey dey share dat kain loyalty to Trump. Di Florida lawmaker na one of di president elect most gingered defenders, weda na for congressional hearings, for press conferences and for television appearances.